Friday, December 21, 2012

WETIN MY CHURCH DO FOR ME



Na so so hunger wire me
I run go meet my pastor
He com dey search for something
I think say na money
He comot tithe register

Na him economy crash
I no com get cash
I go meet church
Where I dey pay offering
They tell me say money no dey.
I wonder where all my money go.

I contribute money for church university
They talk say na God work
I even help them build am
After the school complete
My salary no fit send my pikin go the school


Pastor say make I be church worker
I work well well
All my money and time I give dem
Small contribution like dis
I go chuk hand for pocket
I no sabi say
 na the money na him pastor
 Go use buy private jet
And him wife limousine
Me still dey use my benz; leggediz benz

My church dey collect taxes pass government
Even the one wey they suppose give Caesar
They go ask for am
For Sunday we dey give offerings wey get different names
Tuesday na to sow seed
Thursday na prayer offering
I com dey wonder,na who dey do the work?
God or pastor

Make una no stone me o
But as I sit down now
I still dey think wetin church do for me
Even when person die
They no go ask if him be Christian
They go ask which church him dey go

ROUSE OF THE SOIL



My legs dance!
Dance! I said.
For the ancestors blow you a flute
The spirits of the land play you drums.

But you say. . .

The song by the gods
Is a bitter pill,
It churns my tummy.
I won’t dance.

You, son of the soil dance!
Dance! I said.
For the ancestors blow you a flute
The spirits of the land play you drums.

Aha! Eeeeh!  Igbo kwenu!
The song of the gods
Drives my spirit into a frenzy
And I dance.


Dibia!
Pour out a libation
Let us celebrate
For I have the lips of the gods
But not their status


In the spirit land
My ancestors call me
 A reincarnation of Onigbo
The mouth of the Igbo’s.
Who art thou?

THROES OF SACREDNESS



I walked through that darkness of sorrow
And saw men dancing
At the crossroad of sacrifice

A burning fire beckoned at me
Around it, they danced
And laughed

I grew weary,
Not self pity but a fight
They had done the same

My knees crashed
The fire burned
The party stopped

They whispered
We are the pillars of Africa
Fail us not