Friday, December 21, 2012

WETIN MY CHURCH DO FOR ME



Na so so hunger wire me
I run go meet my pastor
He com dey search for something
I think say na money
He comot tithe register

Na him economy crash
I no com get cash
I go meet church
Where I dey pay offering
They tell me say money no dey.
I wonder where all my money go.

I contribute money for church university
They talk say na God work
I even help them build am
After the school complete
My salary no fit send my pikin go the school


Pastor say make I be church worker
I work well well
All my money and time I give dem
Small contribution like dis
I go chuk hand for pocket
I no sabi say
 na the money na him pastor
 Go use buy private jet
And him wife limousine
Me still dey use my benz; leggediz benz

My church dey collect taxes pass government
Even the one wey they suppose give Caesar
They go ask for am
For Sunday we dey give offerings wey get different names
Tuesday na to sow seed
Thursday na prayer offering
I com dey wonder,na who dey do the work?
God or pastor

Make una no stone me o
But as I sit down now
I still dey think wetin church do for me
Even when person die
They no go ask if him be Christian
They go ask which church him dey go

No comments:

Post a Comment